First lady of nigeria biography for kids



[MEMRES-5]!

Oluremi Tinubu: Pastor and three term senator wey become Nigeria first lady

Wia dis foto come from, Oluremi Tinubu/facebook

Article information
  • Author, Kareemot Salami
  • Role, Broadcast Journalist, BBC Pidgin

Di position of first lady for Nigeria na one wey dey respected wella sake of di important role wey anybodi wey be wife of president dey play for society.

Oluremi Tinubu, di woman wey currently dey hold di position na one powerful woman and ogbonge politician herself..

Di name Oluremi Tinubu already dey popular inside di kontri.

Dis na sake of say Mrs Tinubu don already occupy one ogbonge political position inside di kontri.

She be Nigeria Senator wey represent di Lagos Central constituency for di red Chamber of di National Assembly three times.

After e gbab im certificate of return as president-elect, Bola Tinubu bin tok say im wife no dey return to di senate - she no participate for di election too.

“To my lovely wife, Oluremi Tinubu, you di s